“Stay away from those people who try to disparage your ambitions. Small minds will always do that, but great minds will give you a feeling that you can become great too.”
Na person wey never see problem dey use English dey pray. Book wey no gree enter head go enta exam hall Goat wen get mind follow lion go catch fish, make e know say weda dem catch fish or not, Lion food don set oh. Who naked no dey chuck hand for pocket...! Wetin concern dog wit family planning?.. Na determination dey make Okada overtake trailer for road. This one good, this one good na em mad man take dey gather plenty load. Pikin wey go strong go strong.... No be say until dem name am Samson. Na over confidence make February no complete. Do you know who I am? Do you know who I am?..Naso hold up take dey start. Head wey no wan think go carry load.. Hand wey stay long for pocket, know say nothing de that pocket. Forget Trust If trust dey, Water nor for boil Fish. No matter how lizard do press-up reach, e no fit get muscle pass crocodile E de clear pimple, e de clear pimple na so bleaching de start. Feel at home, feel at home na eim dae make visitor spoil remote Escort me, escort me nas...
Perfectly said.....
ReplyDelete